Legendary singer Daddy Showkey don yarn say na Wizkid help am enter Instagram life. According to the galala king, the whole thing start when he visit Wizkid house some years back. Next thing, he see say Wizkid don post him and everywhere just dey buzz. He ask, “Wetin be Instagram sef?” Na there Wizkid come explain give am and even help am open the page!
But that no be all o. Na Kcee come later teach am how to sabi use the app well-well. Showkey talk say the app really change many things for am and e make am dey learn new things again like small pikin. In him words, “Life na to dey learn, and apply wetin you learn.”
This one just show say Wizkid no be just star for music him sabi show love and carry people along. Real respect!
Views: 293
